One ghost operation wey Cameroon opposition leader Issa Tchiroma Bakary don impose afta im lose di October election, scata economic activities for many parts of di kontri.
Dis na ahead of di 92-year-old Paul Biya swearing-in to begin fresh eight-year mandate.
Oga Bakary claim say im win di presidential election wey im tok pipo to protest di results by sitting for dia house and closing dia shops.
Since Monday, di pipo of Cameroon dey observe dis order in many ways.
Mohamadou Alhadji dey operate one barbershop for di northern city of Garoua wey be Tchiroma Bakary im hometown and stronghold.
E don close im barbershop since di ghost town operation sake of e dey fear say dem go destroy am if e open am to work.
“I no wan make kasala pipo destroy my shop,” he tok, as e refuse to listen to di govment calls to stop civil disobedience.
“Govment go give me money and pay for my shop if dem destroy am?”
Mohamadou no dey alone – many odas dey respect di ghost town operation.
Oga Bakary get plenty followers across di north, so many pipo say dem dey obey di order to support his political fight.
One trader for di Garoua central market – Ousmanou Ibrahima explain say “we will no go open, we accept dis [ghost town] order wey dem given.”
E tok BBC say he wan change for di kontri na so he dey support di former govment toktok pesin, Issa Tchiroma Bakary im side of di tori say im win di election.
“We dey obey dis order, na im be our president,” anoda supporter Abdulkarim Nassirou wey be taxi driver for di same city, tok.
Even though im dey support di ghost town order, e tok say e don dey affect him as he dey struggle to provide for im family.
“Tins don hard well well ova di past three days, and we no fit to chop what we want chop sake of we no get money.”
Despite dis, he say im go still support di ghost town order if dem stretch am to more days.
For Garoua, like many oda parts for di Central African kontri, wey get about 30 million pipo, busy streets, schools, markets and health centres no dey work fulltime.
Dis be different from wetin dey happun for di capital Yaoundé – wia pipo dey go about dia work.
“I no fit stay for house,” one old pesin wey dey sell fruits for di roadside for di city centre tok.
Im dey watch over im oranges wey dem arrange on top a tray, as she tok di BBC say dis na her only source of livelihood.
“I dey under pressure to go out because I no go get what to eat if I no go out to sell.”
Few meters away, Maleke Seldei dey prepare to display im phone cases for sale afta im notice say many pipo no dey respect di ghost town order for Yaoundé.
Im decision to comot to work na sake of govment give assurance wey oda pipo dey go about dia work also.
Di authorities already tok say make pipo no obey calls for “insurrection,” ghost towns, and civil disobedience.
Throughout di ghost town period, govment admin officials dey on di street to encourage business pipo to open dia shops.
For di economic centre Douala, wey be di centre of post-election violence, pipo don resume dia business and school activities low-key.
Many odas dey careful wey dem no be sure about wetin go happun, as tori bin dey go round say food prices and oda tins don rise.
Odas simply close dia shops wey dem stay for house to avoid cases of vandalism.
Di Human Rights Commission of Cameroon say at least 14 pipo die during di post-election kasala between security forces and protesters, wia dem arrest and detain ova 1,200 odas.
Dem also destroy public and private properties, according to di commission.
Di ghost town order don also affect urban transport services.
On Tuesday di Transport minister Jean Ernest Bibehe bin meet wit pipo for di sector wey im assure dem of safe and smooth transport across di kontri.
Di effects of dis ghost town order don overshadow preparations to swear-in president-elect Paul Biya on Tuesday.
Currently Paul Biya be di oldest president for di world, his new seven-year mandate go make he rule until he go chop almost 100 years.
Biya wey already serve for 43 years go begin fresh mandate wit allegations of crackdown on di opposition, youth unemployment and security wahala.
